Man Caught Buying Goods With Fake Money In Delta State (Photos)

ADVERTISE HERE

ADVERTISE HERE

A man who has been buying goods with fake money was nabbed in Delta.He
was nabbed while trying to buy ‘Pig’ from two small boys after
previously deceiving a lady.He was beaten and disgraced.Below is what an
online user shared in pidgin…..

‘Report reach us for studio
say e get one guy wey dey use fake money dey buy things from people and
he go still dey collect the change. One girl con go fall victim for the
guy yesterday. Mainwhile, the girl brother see the guy from window as at
wen he dey buy something from he sister hand. So the guy con tell he
sister say make he nor worry say if he see the guy he go fit still
recognize the face. So unfortunately, the girl brother con later catch
the guy for TM junction as he dey wan buy Pig from two small boys hand
for the junction. Naso the guy take tell the bike guy to turn the bike
go where dem dey, and as he reach there, naso the girl brother catch one
of them, because na him with the one wey dey ride the bike dey work
together. Naso dem bruise the guy face turn to igbudu monkey. Na finally
dem call police to come carry the guy go station make people for nor
beat am die there. During the process of beating the guy nai dem later
see some of the fake money for he pant. Na the guy picture and the fake
money nai wey dey top of he head nai dey attached to this update so’


{Naijafinix.com}

ADVERTISE HERE

CLICK HERE TO COMMENT ON THIS POST

Do you find Naijafinix Blog Useful??

Click Here for Feedback and 5-Star Rating!



Be the first to comment

Share your thoughts

Your email address will not be published.